Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
CryptopreneurBrainboss
on 11/12/2022, 07:31:24 UTC
NEWS UPDATE: House of reps orders CBN to halt new cash withdrawal limit

Following the announcement wey CBN make, say dem wan limit the withdrawal of cash to N20,000 daily and N100,000 weeky for individuals and N100,000 daily and N500,000 weekly for organisations wey suppose take place on 9 Jan 2023. The house of reps no gree at all about this recent infoment, and as a result them don order CBN to stop the implementation of this new policy and them don send the CBN governor Godwin Emefiele letter make him appear before the house on 15 December 2022, make him come torchlight about the new policy and tell them why dem go allow am to stand.

https://community.thenationonlineng.net/forum/breaking-house-of-reps-orders-cbn-to-suspend-new-cash-withdrawal-?xg_source=twitter

CBN na independent body na, Reps no fit order them to stop anything abi I dey confused the power wey CBN get when e comes to monetary issues like this. If them get the support of the president then e supposed be one way ticket to implement any policy wey dem know go favour our currency. Sha I been never talk for this matter since e come up so make I talk small, people wey think  say POS people go run out of business no understand wetin this new rules go do for them.

Government say na only ATM go dey remit 2,2 hundred Naira note oh dem no say POS follow and beside POS na individual businesses wey fit dey remit any denomination wey dem want meaning businesses go dey go well for dem. The maximum limit go affect everyone sha but with POS you fit they collect 200, 500, 1000 etc and trust Nigerians dem go use fees kill us.

Baba... abeg I dey find am difficult to use the poll, I done touch the options wey I wan pick but e no dey response, and I come dey reason am say maybe the time for the poll done elapse, and another thing be say no be only thread I dey encounter this difficulty. Abeg why e be like that? abi e get wetin I no dey do right?

After you click the option wey you want, click submit vote. If you no click the submit vote then vote no go count.