You no need to bother yourself too much about this matter my guy, if dem implement dis then even the market people go improvise, na because dem never introduce am you dey reason say e go hard. Even person wey no go school now fit operate and use ATM machine. Before dem introduce am for even civil servants to dey collect money from bank instead of table payment dem been grumble but now dem prefer am like that. Anything wey person put head say him go do, e go definitely work out like that. Make we just dey watch see how the matter go be after dem implement am because I no see any reason wey dem go stop am now since e don reach dis stage like dis.
The thing be say for this our very country we like to jump into conclusions without proper investigation and analysis. We go just sit down for chambers dey talk I hear say this and that. If you really take out time to go through this new policy you go realize say CBN really try with this new policy. Is not that you can not spend more than 20k a day as majority of us dey think. You go fit spend millions or billions of naira a day but all transactions must be traceable na wetin CBN dey try achieve be that. Even the reps wey wan make dem reverse the policy na for their selfish interest and not for the interest of Nigerians.