Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Obari
on 11/12/2022, 21:37:47 UTC

NEWS UPDATE: House of reps orders CBN to halt new cash withdrawal limit

Following the announcement wey CBN make, say dem wan limit the withdrawal of cash to N20,000 daily and N100,000 weeky for individuals and N100,000 daily and N500,000 weekly for organisations wey suppose take place on 9 Jan 2023. The house of reps no gree at all about this recent infoment, and as a result them don order CBN to stop the implementation of this new policy and them don send the CBN governor Godwin Emefiele letter make him appear before the house on 15 December 2022, make him come torchlight about the new policy and tell them why dem go allow am to stand.

https://community.thenationonlineng.net/forum/breaking-house-of-reps-orders-cbn-to-suspend-new-cash-withdrawal-?xg_source=twitter

Boss just incase una still dey debate this matter see my bank don send me email and it's really disheartening how this people no dey even consider the common man