Thank you my brother for the update. Dem don too decieve us say our votes no go count and yet dem dey buy PVC. If vote no go count why dem dey buy PVC? Why dem dey share money for polling unit to carry influence our conscience.
Make everybody stand up for the truth.
Stand up against people wey think say na dem get this country.
Stand up against "my turn" people wey don already share the country positions without our consent.
Stand up for those who don dey thief and wan be president since 1993 till date and yet dem go talk say na youths be the leaders of tomorrow.
PVC na e sure pass but still manipulation dey coded, how some people day y get like 5 PVC for hand on that day,and dem go use all the five cards vote just because of to collect money five times,underage na another way to do am.
Anybody wey neva go collect him own wet e do make e quick go now o,because e get as e go tey before u know this INEC people go sell am out to party leaders for the ward so that e go be advantage for them to use am on election day vote without you the owner knowledge. Let's kick out bad government for naija and no be by talk but na by action.