Boss just incase una still dey debate this matter see my bank don send me email and it's really disheartening how this people no dey even consider the common man
Na now I confirm say una get money for this country no be lie. If not how 100k weekly limitation go worry una. Me self I no deh do reach 100k weekly. Where the money even deh to withdraw self. How many people deh even earn up to that amount as salaries self for this country, even graduates? My concern na whether CBN and its partners go make the rule deh for everybody, no be only for the less privileged.
The truth be say even if the matter no concern you e definitely concern someone that is close to you my guy, wen we dey reason say some moves by the government no concern us na when them dey try dey do more.
In the pursuit for a better Nigeria we go gats dey selfless about the matter, I my self no get that kind money but there are some weeks like this way person fit use through me one run figures wey pass that amount.
Wetin I believe is that the country now they like kindergarten play ground them they focus on less important things we no go improve the economy like the new coloration of the naira because I no go call that one new design and now this one. Make them focus on things wey go at least give our currency value.