Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
CryptopreneurBrainboss
on 18/12/2022, 13:20:52 UTC
Na the prayer wey dey many people lips right now. As onto recently news just dey fly every where about burning of INEC offices, we hope this one no go discourage the fairness as PMB talk.
Na one chance for another 8years, make those wey never collect try make time to go collect am o. At least na the way we know best for now.

If you ask me ehh, I go talk say this year INEC go dey fair for presidential election but you dey see the other ones wey nobody dey reason. The kind rigging wey go dey there ehh, only God knows. INEC know say eye dey this presidential election so them go commot hand make the world no judges them than focused energy on cashing out from other smaller position wey people go wan buy. Anybody wey win this election, go be people choice and I no just mean social media choices I mean those we get PVC and go comot their unit come vote.

Anybody wey wan win this election go need hustle for grass root, leave social media as na youths wey go just deceive you full there. On that day self dem go focus for another thing leave the vote wey dem supposed go vote. I no say make you leave the youth entirely but focused on those wey dey come unit and not online ones. We get many online voters wey he say if them been gree go get PVC come unit then for make great change for the outcome of elections but them prefer to hide behind the social platforms the air their views.