Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria is known for scam by the people of the world,while we seeam as street.
by
KupaCrypto
on 22/01/2023, 20:19:24 UTC

Make I shock you, if you dey talk of real scammers like men wey dey work with laptop defraud companies, organization wey be say dem be big shot, Nigeria no even follow for top 5 or ten self but na just say our lavish lifestyle dey kill our name because dem know say normally we poor for this side so anybody wey come dey live over large as our people sabi do na scammers. Also our African brothers dey portray demselves as Nigerian away most times so when dey catch dem dey gi say na Nigerians.

Nigerians are hard workers like the real ones. Oyah see us for here na, e get any other people wey hustle pass us I mean posting hustle oh no be all those bounty hunting (even there we still get representation). People self come dey jealous as e come belike we dey get am easily when den no realize say the level of hustle wey we dey put inside this forum much pass wetin others dey put in and we suppose dun get more recognition then dis

Sha just no reason am too much, no be say we dey celebrate fraud but Nigerian just dey find anything wey go make dem happy. We sabi find humor in every situation that's why e dey like we dey celebrate the fraud but Jo be so, give any Nigeria work na and see how him go over deliver instead wanting to join the street. That way self no easy as ritual dun enter the whole thing and wetin many people dey do now na ritual come use street cover up.
No be lie Nigerians the hustle real hustle o, tho the bad hustlers still dey sha, even Nigerians when dey reach other countries dem dey carry the hustle for head. This scammers done spoil the country name for outside, becos the outside world now done dey see every Nigerian to be a scammer but dem no know say the good ones wey dey hustle right even plenty pass the scammers,
This forum I believe say na Nigerians full oo,  even to do the scamming hustle no easy too bcOs before u scam oyibo person you need some level of smartness,  and e no easy at all.

Nigerians no scam reach some kind countries just that na our own dey too pronounced, and that na becos we too like lavish lifestyle.