Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria is known for scam by the people of the world,while we seeam as street.
by
Aliosky
on 11/02/2023, 10:52:15 UTC
Nigeria don dey among countries wey dem see say na dem Sabi scam pass for the world,and the way me I see the thing,e be like say we take glory inside the talk.So tey we don kukuma dey Callam "street."
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?
I tell you my brother the thing no they sweet me at all, for all these embassy guys to grant Nigeria visa now na problem because of waiting they done tag us and if  na scam nigeria no scam reach all this oyinbo guys both their male and female esspecially for crypto, but any small thing now they go carry tittle give us. The  truth be say our people to get for body if an that one,I know say he no easy but even at that no be excuse to scam.
Normally you see all those oyinbo ba na racist dem be, dem just de gind small excuse wey dem go use spoil our name i just believe say dem no like black people and if e possible dem go even want make separate their selves with black people. Check even the way dem de treat black people even for that their side even footballers de complain about the same thing. But all this things sha na we give dem mouth talk am because the way yahoo take cast even small children wan de do yahoo so if you check am na yohoo boys  con de flex pass even people wey get legit work and our president con get agenda against yahoo boys na wetin cast everything be dat na why dem get mind spoil our name be dat.