Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Kaduna would still accept old naira note
by
Mr.right85
on 20/02/2023, 19:19:23 UTC
Wahala no they finish for this country oh, governor for kaduna tell him people say old and new naira note go still they in use say make them no fear till the Supreme Court decide other wise, talk say any person or any facility wei reject they old naira note go face they consequences.
Visitors go choke for kaduna state oh.

Na statements like this they make me say Buhari na mumu man a d his government na big setback for Nigeria, how a president go give order and a governor go wan go against the order. The worst part no be say the governor dey the opposing party and him wan just create misunderstanding but this one na him tight party person wey be Nasir Ahmad el-Rufai like instead of you to work with your president so una fit make everything dey okay. Maybe him dey find favor for him people hand so dem go elect APC again for Kaduna. Punishment suppose dey for this kind thing.
No b small tin o, imagine am na. Dis kind tin go mak u wonda if na dis same naija all of us dey or we naija no get supremacy over all of en territory.

No mata watin en dey fine 4 en pple, evn as d life hard lik dis, na evry bodi e hard 4 nd e supposed dey called 2 order 4 dis kind tin. Na revolution against CBN nd d presidency b dat o. Na dem knw watin dem dey do shah nd wen matas lik dis kind go unchecked or handled, e dey giv anode persn mind 2 attempt evn watin ft pass dis one.

Na why u go hear say, we no get law 4 naija. Pple go jst dey fault supreme court directives nd notin go sup. E cast wella.