Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Kaduna would still accept old naira note
by
Wiwo
on 20/02/2023, 23:33:43 UTC
Wahala no they finish for this country oh, governor for kaduna tell him people say old and new naira note go still they in use say make them no fear till the Supreme Court decide other wise, talk say any person or any facility wei reject they old naira note go face they consequences.
Visitors go choke for kaduna state oh.



Make we forget say this policy come with big shock but we know say e no bad at all especially if we fit implement am well wey be say big cash no go dey dey outside the banks again. Any transaction go be electronically wey be say, person fit obsessed where the money dey from and where him dey go. E go bad for some political propaganda as dem fit use this spying dey monitor person but some kind crime like kidnapping for reduced unless kidnappers go wise up they use cryptocurrency lol.
The matter surprise me oooo, the governor of Kaduna state Ahmed Nasir El-Rufai is a big shame and I do believe say a person who claimed to be a technocrat will speak against a policy like this and order his people to go against presidential order but I trust federal power, them no born El-Rufai well to do otherwise and the question be say the old naira no dey like that again even as he says to make people for Kaduna accept old notes, the question be say how many of the old naira note still dey people hand, bank don already collect most of ammm from people unless those politicians were donned stash large amount of the old note before this swap policy.
-I no expect this kind of level of criticism to be coming from members of the rolling party and I no expect strong party nan like El-Rufai to make such a negative outburst against a federal policy where many within his state are sacked from their homes due to terrorism, kidnapping and banditry which is one of the major areas were the currency swapping is targeted at.