Wahala no they finish for this country oh, governor for kaduna tell him people say old and new naira note go still they in use say make them no fear till the Supreme Court decide other wise, talk say any person or any facility wei reject they old naira note go face they consequences.
Visitors go choke for kaduna state oh.
Na statements like this they make me say Buhari na mumu man a d his government na big setback for Nigeria, how a president go give order and a governor go wan go against the order. The worst part no be say the governor dey the opposing party and him wan just create misunderstanding but this one na him tight party person wey be Nasir Ahmad el-Rufai like instead of you to work with your president so una fit make everything dey okay. Maybe him dey find favor for him people hand so dem go elect APC again for Kaduna. Punishment suppose dey for this kind thing.
During the time of Goodluck Jonathan tenure, no be as governors take the castigate and am upon and down, even his south-south governor brother "Amaechi" follow join suit. Wey make our man the address Jonathan as weakly president. The same thing don happen to Buhari.
You see this our governors, I no know whether na the immunity wey them d give them as governors the shark their head to challenge the number citizen of a country. Elrufai for try this bullshit for em first tenure, to see whether em for win 2019 election. Lucky em be sae, Buhari and am the step down from office at the same time, if not that, Buhari for take Elrufai to nga(prison).
You see this election wey go on Saturday, Buhari go use am deal with all this governors and politicians wey don disrespect am. Em no go give them chance to do election malpractice for their states