Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigarian woman finds drugs inside crayfish she was ask to deliver abroad
by
DONZAKA
on 28/04/2023, 10:49:00 UTC
Abeg my people Wetin una fit talk for this kind matter ? This our country where are we heading to? With this wahala everywhere everyday.

https://www.youtube.com/watch?v=iBUgP1Metbo
To even help for this country now na wahala, u get pure intention to help person, but na bad intention the person get against u, if u know say u wan carry drugs, why u no carry am urself, you wan put person wey no sabi anything for problem. I no fit wan travel out and person go talk say him get message to give person for where I de go, I no go collect am ooo, even if u go think say na bad person I be but I no go collect am, you go find another means to send am, u no go put me for wahala. Abeg make we all de careful if u wan collect message from anyone, make sure say u check wetin u wan collect very well first, no trust anybody now ooo.
Some people dey too lousy too. Small thing them don cast their matter. If she no been make noise about her travels, who for see am give drugs. She get luck sha say na for house she discover am... My advice na say make she start drugs business one time if the drugs plenty; make money then carry the crayfish and other things go give that person sister.

If them born am well make she ask you careless question.