Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigarian woman finds drugs inside crayfish she was ask to deliver abroad
by
Stable090
on 28/04/2023, 17:13:19 UTC
Some people dey too lousy too. Small thing them don cast their matter. If she no been make noise about her travels, who for see am give drugs. She get luck sha say na for house she discover am... My advice na say make she start drugs business one time if the drugs plenty; make money then carry the crayfish and other things go give that person sister.
Everyone wan show say de wan commot for country, but make we no still blame the woman, if you wan travel de get some people wey u no go fit hide am from, some of ur family members go definitely know and incase if de talk say de wan give u message make u give person for their u no go fit talk No. D woman just get luck say she check am well before she arrange am for her bag, na for jail she for go land and she no go fit denial am say no be she get am. She de very lucky ooo make she just de thank God and I de very sure say she go don learn her lesson, if she de travel now she no go collect any message again.