My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.
Na so the country dun grow reach now, ritual dun dey so common wey be say we dey praise am and na wetin deh cause all things. This ritual matters na majorly wetin they make people miss and also kidnapping. I no just understand wetin the government and securities agency for country dey do. Abi dem no dey pay them again to protect us. As e be like dis belike dem go begin approved personal arms because person need gun to take care of himself this day as if dem come for you, nobody fit do anything even the police self no follow.
Our girls too no dey try, na so so wake full their legs. How you go just meet person for online either through Facebook or other social media and you dun dey follow them go house. The worst na the hookup hustle we dun dey so common wey be say 90% of our girls especially university girls na wetin dem dey do and dem sabi go this boys wey book them houses without any security like telling person where dem dey go. How dem go carry tell person self when the hustle wey dem dey do no pure. Make girls give themselves respect and hold their self well because all this problem no dey too near those wey dey respect themselves.