If you have N100,000 how would you invest it? Here is what someone recommended based on their own experiences, knowledge etc. They broke it down into 3 categories - Low risks, medium risks, and high risks investments. Continue reading . After reading it, I'd like to read your recommendations too.
How would you invest N100,000? Break it down into 3 categories - Low risks, medium risks, and high risks investments.
Who dey say #100k too small, I hope say una know say minimum wage for the country na #30k and we get people wey no fit saved out #100k at the end of the year if not for other side hustle wey dem fit dey do. I dey see say crypto dun spoil una to the extend una no dey value Nigeria money again. If #100k too small carry am enter street and dash 10 people #10k then watch the joy wey go dey dem faces when they received that money wey be just 10% of wetin una dey talk say too small.
If na only #100k I get to invest, and I need divide am into 3 ways as you talk see as I go do am. 50% go into crypto investment wey I go consider high risk and I no go buy Bitcoin. I go closed eye put am for any of those these two altcoins wey I know say my money no fit loss anyhow like BNB or Ethereum. The target go be to get like 10x for this coins or atleast 5x go possible before next bull market finish wey go make that 50k either 250k or 500k.
Na when peso broke na when em go know the value of the little Nigeria money wey em d see for hand and how valuable it is.
It is true sae crypto don spoil many of us for head for us to take 100k as small change. I remember when peso no d see change for pocket, any small amount like 10k wey em see, em go last for am for weeks before em go finish. But nowadays peso don the think anyhow like sae 100k don become small change for hand.
As em d now, em no go make sense of me to think sae 100k na small change no matter how em d see money. Imagine if peso carry that 100k put am straight into altcoins wey get potential and leave am there till bull run start. Imagine how em go be nah. Peso go blow be that nah.