Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: How would you invest N100,000?
by
Smartvirus
on 12/05/2023, 20:01:16 UTC
If you have N100,000 how would you invest it? Here is what someone recommended based on their own experiences, knowledge etc. They broke it down into 3 categories - Low risks, medium risks, and high risks investments. Continue reading . After reading it, I'd like to read your recommendations too.

How would you invest N100,000? Break it down into 3 categories - Low risks, medium risks, and high risks investments.

Who dey say #100k too small, I hope say una know say minimum wage for the country na #30k and we get people wey no fit saved out #100k at the end of the year if not for other side hustle wey dem fit dey do. I dey see say crypto dun spoil una to the extend una no dey value Nigeria money again. If #100k too small carry am enter street and dash 10 people #10k then watch the joy wey go dey dem faces when they received that money wey be just 10% of wetin una dey talk say too small.
Real matter o, e get many for the country way no dey archive am before the year run out but, that no mean say, the money plenty shah. The devaluation of naira don make #100k common for eye and crypto don spoil people wella, that one na true. Na why many people and this one no be just within our people but, the world dey reason am like one get rich quick scheme.

If na only #100k I get to invest, and I need divide am into 3 ways as you talk see as I go do am. 50% go into crypto investment wey I go consider high risk and I no go buy Bitcoin. I go closed eye put am for any of those these two altcoins wey I know say my money no fit loss anyhow like BNB or Ethereum. The target go be to get like 10x for this coins or atleast 5x go possible before next bull market finish wey go make that 50k either 250k or 500k.
If we reason am for those way dey do from hand to mouth kind of lifestyle and them go like invest that money; crypto no be option o. How long you wan wait kwanu? You no go even fit reason trading because, 2sec them fit collect all from your hand. One place way I feel say gor nice for hand to mouth people na on food.

All these people way dey cook food for student environment. Once your cooking nice, people go patronise you and you grow from there.