If we reason am for those way dey do from hand to mouth kind of lifestyle and them go like invest that money; crypto no be option o. How long you wan wait kwanu? You no go even fit reason trading because, 2sec them fit collect all from your hand. One place way I feel say gor nice for hand to mouth people na on food.
All these people way dey cook food for student environment. Once your cooking nice, people go patronise you and you grow from there.
You dun think about the disadvantage for food business. What if one day people die from eating at your restaurant wey fit be your fault or not. You dun lose customers be dat oh that's if dem go allow you to dey sell there again. Food business sure but stress dey am and sometimes the profit no go come out due to increase in food items for market. If you ask me make I choose I go prefer investment wey go bring capital gain then restaurant wey go bring cash flow although cash flow dey very necessary for life.
Right from time me dey like capital gains that's why I dey find am very difficult to do manual businesses. Anything wey get to do with business with me, I dey like am online wey be say me fit manage am without leaving my bed. I no like too much stress although I get your point very well but the house , how una see am. Make una forget say una dey Bitcoin forum. Make we talk like brothers for here, between crypto investment and that fast food establishment wey our brother dey reason. Which one for sure pass no forget the budget wey dem give us above oh.