Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread.
by
Framelover
on 12/05/2023, 23:28:59 UTC
⭐ Merited by Mpamaegbu (1)
My Username na ‘Framelover’, I be guy man wey get interest for crypto. I wan learn more about Bitcoin and other digital money dem. I lyk to trade, invest n I wan explore d potential of blockchain technology. I get Joy say I fit to connect with una and learn from una.

My naija people I hail una. I de very happy say I enter for place like this, I don even feel at home before una welcome me. I still be newcomer for this bitcoin, abeg I humble my self to learn, I thank una well.
Framelover and Kelward, we take open hands welcome una two for owa midst. I like as una talk sey una dey ready to learn because na dat wan be d koko wey make everyone of us enta here and then we com realize sey honey dey here too. Betta honey oh. Make una go thru d rules and keep dem. Nor plagiarism other people articles or spam for forum. If you nor keep all these, see you see ban but if you keep dem, see you see Shiloh as one of owa ogbenge members go yarn.

Oya, una welcome, wey bread 🤗

Edited
Sorry iBaba, I nor sight you before. I welcome you too.
Omorr e just be like na celebrity reply me… as I de sight u so e just be like na wizkid reply me… u don too bam for dis forum no be chais.. ur merits de inspire me boss. I de loyal and local 🙌 I dey appreciate your warm welcome nd I know say learning nd following d rules be d main tin for dis forum. E good make I hear sey honey choke inside too but me I no de rush, na slow and steady I de move. I go read and follow the rules make I no chop ban. I dey look forward to engaging with the community. Thanks again Boss, Una plenty wey de inspire my for here.
Clear Road for senior men dem 🙌
Sharp 📌