Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The way our girls dey miss this days
by
letteredhub
on 14/05/2023, 03:39:09 UTC
My people i no dey understand this our country again oh.
You go see person today especially girls before u know she don disappear in the name of visiting friends.
  The one wey just happen last night just tire me,my two neighbours pikin wey be girls go there friend birthday party till now them still them still dey look for them.
I no just understand the pattern of the country again.
D rate at which young guys dey look for money now don too much, dey are ready to do everything possible just to make this money, and girls also, their eye no dey stay one place, na guys wey go spoil them with money dem dey look for, some of them know say Wetin d guy wey dem dey follow dey do no pure, but dey go still dey follow the guy just because of the money wey dem dey get from the guy.
All this gen-Z girls them no get joy for any hustling young guy side oh, them no the see you self as person way get future as far as you never get money to the spend spend anyhow on them. And wetin the pain me pass nah be say same girls them get brothers way never make am but them still get hope say their own brothers go make am but them no get hope for another guy way the hustle too say him go make as to hustle together with the guy, them dey find where don already done make them com relax chop, and nah all these things the lead to some impatient and indiscipline guys to go the pit their hands for bad things just to impress them girls .

But my own rhetorical question be say, if we guys too start to the date women primarily for money reasons nah which girl go actually get boyfriend cos the last time I checked plenty girls broke finish, as in like 90/100 girls nah broke ass.