Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria and the new government
by
Rruchi man
on 01/06/2023, 16:07:00 UTC
All I can sey is dat we're in for a disastrous ride. My people talk sey na d smell (odour) of mess dem dey take know the taste of shit. We don see how e dey go now wit just one day in office. Baba Blue–laba don begin show us renewed shege.
Apart from our government, e be like we dey do ourselves wicked well well. You remember during that time wey money dey scarce too, how POS people been dey use us dey cash out with their very high withdrawal charges, na so fueling station owners dey do right now. Our new president should not have been quick to announce subsidy removal like that, it has made fueling station owners to start hoarding the product and selling at ridiculous cost for a litre.

We nor fit just cun dey blame Tinubu now now, na just talk e talk, people wey we suppose carry eye face na the people wey decide to immediately begin to sell their old products at new price, na dem dey cause all this problems.