All I can sey is dat we're in for a disastrous ride. My people talk sey na d smell (odour) of mess dem dey take know the taste of shit. We don see how e dey go now wit just one day in office. Baba Blue–laba don begin show us renewed shege.
As him don talk say renewed hope, na the hope be dis? Na so we go take start am with dis new government? One tin I know be say and I believe in wella na him be say dis Naija go better whether na through difficulty or no. Dis kind shege, we neva see am before but make we just dey believe say better days dey ahead for us. As we no say, every good tin no dey come easy, we gatz pass through dis vigorous process to make tinz right. I been vex before, but na only the word wey say, “there’ll be light at the end of the tunnel” still dey keep my hope alive for dis renewed hope.