All I can sey is dat we're in for a disastrous ride. My people talk sey na d smell (odour) of mess dem dey take know the taste of shit. We don see how e dey go now wit just one day in office. Baba Blue–laba don begin show us renewed shege.
If we can survive Buhari 8 years tenure as the president of Nigeria, I believe we can all survive anything wey Tinubu government go bring come to the table as em the rule us for the country.
Em d very unfortunate sae our rightful candidate no win the election but still yet Tinubu don become our president and we gat to accept am with good fate until the tribunal give their final verdict about the presidential election of who win or not.
You no wetin the give me concerns of late be sae how our electoral voting system go be in the future if finally Tinubu succeeds running us in his first tenure and nothing happens via tribunal making a proper judgment towards the election rigging brought before them. You go know sae anything like voting during the election period don end for millions of Nigerians side. People no go get mind to come out to vote ever again. Peoples mind go be, after wasting time to vote, INEC go now select who d want to win the election. So no need of voting since peso vote no d count again for Nigeria election