Dis one no shock me say this update dey come out just before the bull market wey be say investors go begin full the crypto market wey dey come ahead. E dey always surprised me when Kucoin no be decentralized exchange but an average player for the centralized exchanges industry yet e still dey run no KYC parole and SEC never come for them. Well I been know say na just a matter of time before dem go join others dey begin dey make am compulsory say make we all run our KYC verification. See eh e no bad when this centralized exchange dey request am because they're mandated to know their customers to avoid any mumu business wey men wan use their exchange dey run.
The dimension way you take for this one na watin i no been reason shah but, na the real matters way fit follow be this. E fit still be say, them dey prepare themselves for the policies way fit come rock there house later in the bullrun via say, come the pump in bitcoin price, na so you go find out say, all those agencies like SEC them go remember there rules and go fine people to make victims.
But for the sake of privacy, those KYC no make sense and that's why we get other options wey be say people fit dey use and they stay anonymous. I just dey pity kucoin exchange because some of their customers na people wey dey run away from all this KYC wahala so as kucoin before no been dey request am.
Na risky move for them shah but, e get watin them wan avoid and e get watin them hope to gain shah. KYC or not, you go still lose customers at some point and loyal customers no go still run you via KYC. For you to Dey trade certain amount on Kucoin, e define the trust way you get with them and base on that, people way go run am dey.