Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: I want to place advert for my customers to fit pay me with bitcoin.
by
Mate2237
on 13/07/2023, 19:35:16 UTC
OP, nobody get right for Nigeria to tell you say make you no accept or use bitcoin because na we dey carter for ourselves. Government abandon their work wey be to take of citizens,come dey thief our money. Bitcoin in business will add more advantage to your sales because you accept varieties of currency. My only advise as Brainboss talk put am on the low,anything to put am for social media say you dey accept bitcoin no make sense. Tell only your customers wey you fit contact. You no go regret am,if you take this bold step. You to also understand say bitcoin na volatile currency, he go better if you know how to do so that you no go run into loss because bitcoin no be like stable coins.
Merit.s why you dey tok as if you no be Nigerian. U dey tok sae nobody get right, den why banks obey the CBN order for not accepting cryptocurrencies in their commercial business? Merit.s if Nigerian government can ask Banks to stop cryptocurrency transaction, they can control any other central exchange platforms. U never hear sae , police dey disturb people wey dey use bitcoin in pH. Person don tell me sae police dey worry well well. Dem go tell you sae, government don stop bitcoin so why you dey use am. And in BY if police find out sae you get bitcoin, my broda dem go drain your wallet.