Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: I want to place advert for my customers to fit pay me with bitcoin.
by
blackened515
on 16/07/2023, 02:29:10 UTC
OP, nobody get right for Nigeria to tell you say make you no accept or use bitcoin because na we dey carter for ourselves. Government abandon their work wey be to take of citizens,come dey thief our money. Bitcoin in business will add more advantage to your sales because you accept varieties of currency. My only advise as Brainboss talk put am on the low,anything to put am for social media say you dey accept bitcoin no make sense. Tell only your customers wey you fit contact. You no go regret am,if you take this bold step. You to also understand say bitcoin na volatile currency, he go better if you know how to do so that you no go run into loss because bitcoin no be like stable coins.
To accept country for this kind country, you wan just cast yourself, you forger say our government be don put ban for cryptocurrency, no forget say if them noticed because OP de call attention to himself, na so dem go seize everything concerning e business, dem go even accuse am of embezzling governmental resources, be like you no no as this country worst. Na why anything you de plan to do or you de do, just keep am lowkey, make no body no weytin be your next move. Your customers self, no b all of them you go tell, because people sabi talk oo.