Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Deposit and withdrawal now possible via lightning network on Binance exchange
by
sokani
on 19/07/2023, 21:15:09 UTC
⭐ Merited by EFS (2)
I no too understand di different kinds of lightening networks, wey @charlestin de explain, but dat one no go be problem, na to research and understand am better.
I know say charles-tim don reply you but de one wey him dey talk na LN for wallets like electrum.

E get plenty people wey been dey criticize Binance say dem never add Bitcoin lighning network as part of the services wey dem dey offer, so e good as dem add am, and i believe say now wey Binance don add am, many exchanges go also try add am in the future.
Kraken, OKX, Bitfinex na some of de exchanges wey don already dey support lightning network, so na beta development say de world's largest exchange don follow suit. De integration of LN go benefits Binance users and maybe increase their user base. From de reaction of de news from some their users, I come realize say e get some people wen dem wan send small amount of bitcoin to anoda exchange, dem dey like convert am to anoda coin wey d withdrawal fee dey minimal like TRX before dem send am, and convert am back to BTC wen de deposit successfully reach de exchange. But with dis integration of LN and as many exchanges begin to support am e go help users swiftly withdraw and deposit BTC.