Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 3 from 1 user
Re: Bureau De Change Asking Government to Ban Binance to Save Naira
by
CryptopreneurBrainboss
on 12/08/2023, 07:23:01 UTC
⭐ Merited by hugeblack (3)
Binance P2P been help wella even when CBN been dey worry people wey use cryptocurrency. Naija people were still able to exchange, do business overseas and this help plenty people make a living. This will be very painful if government come ban Binance for Nigeria because plenty people wey create account for Binance used their BVN or NIN to do KYC verification.  So if government ban Binance, them no go get access to these portals and there are other ways them go mandate Binance not to allow Nigerians use their exchange as e suppose be.

Nigerian government no go fit ban Binance P2P, dem fit ban Binance exchange but not the P2P, Binance exchange self no get license to operate for Nigeria (I believe dem no get head office here) so no how wey government wan ban dem unless dem go ban Nigeria IP (through the network providers) just as dem ban Nigeria IP from accessing Twitter few years back but dat one no mean say we no go fit access am as boys go run VPN continue our hustle. Make we leave dat side enter the impact of Binance P2P on the market, you know know say Binance P2P get one of the highest volume of dollar to naira trading for Nigeria and there's no how e no go get effect on the general market.

Binance exchange rate too high, those marchants dey run us street for that platforms. While Naira for black market fit dey trade example, 700/# Binance marchants fit dey run their own 800/#. But I no still support the banning because as you talk e go take away means of livelihood based on how people dey trade dey get small small funds go cum hard. Nobi everybody sabi use VPN so some people go go dey patronized all this local marchants and yahoo boys go use dem cashout. Instead of banning, make dem go into research see how dem go make both parties work in harmony and bring about the best experience to Nigeria because but crypto and forex exchange are here to stay and e no make sense to commot food for Nigerian mouth as dat one mean say you dey welcome back crime for the country be dat.

Note: Binance P2P isn't actually a P2P but a centralized trading between two different individual and there's no guarantee you aren't trading directly with Binance self.