Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bureau De Change Asking Government to Ban Binance to Save Naira
by
Agbe
on 13/08/2023, 14:50:21 UTC
My people, e don happen o!  Bureau De Change (the people wey dey incharge of forex aka foreign exchange) don dey tell federal government to ban Binance to save our Naira.
Dis kind things e no dey shock me oo, because dat government or di parliament e dey full with bitcoin illiterates and dem know no di important of bitcoin so dem dey do weti dem like and not weti the people want. Na so CBN go tell Buhari to take instruction ban bitcoin in banks because he was also an ignorant of the bitcoin technology. Anyone wey dey plan to ban bitcoin and it exchange platforms is not a friend to the Nigerian youths and against the development of the country. Di mata how dem try dem no go fit stop bitcoin in the country.