Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria government don return Bureau De Change!
by
Stable090
on 19/08/2023, 23:07:02 UTC
You are a Sr. Member in di local board and u been dey we dey tok about di Spamming di local board, creating the same threads in the local board.
If dey don create thread before, Wetin e go take u make u just tell d OP say dey don create similar thread before make him lock d thread, Wetin come be d meaning say u carry d rank wey him dey come matter wey dey ground, d OP see say d information dey important to d local board na y him post am. Me self no see d second thread wey u drop d link, na dis one wey I comment I see, and I dey sure say if d Op know say dem don create similar thread before, him no go carry am come here again, na development of d board na him all of us dey look for, if everybody leave d board empty e no go make sense, even people wey apply for merit source how dem go take get am if dey see say our board no dey active. I know say anybody can be corrected, but make we do am in a way that won’t discourage people from posting here.