Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria government don return Bureau De Change!
by
Hatchy
on 20/08/2023, 19:22:38 UTC
My country people, una happy Sunday. As I just come online na e I see this post wey be like say wan dey cause cata cata for our board. This wan no be issue na make una calm down. E no clear say we go dey fight our self here na we be one family for Bitcointalk abeg make we still dey reason. Now the matter we e be say @Mate2237 say op dey spam our local board with dis thread no be true. Even without using any tool self person go know this one. I know say e dey try guide people here for the board. But the wey e take tell op Lida93 no too sharp and with no evidence and clear proof wey be the no 1 thing for Bitcointalk before you accuse person.

The truth be say the two of them just get the same topic body wey dey about bdc BEUREA DE CHANGE. But de two thread has too get similarities.  If you check well, @ Odohu de talk about say binance related with bdc

My people, e don happen o!  Bureau De Change (the people wey dey incharge of forex aka foreign exchange) don dey tell federal government to ban Binance to save our Naira. This one shock me no be small.


But @ Lida93 talk say

Same government wey ban the operation of Bureau De Change (BDC) don come back now com unveil another operational policies for BDC. According to them oh, say the move go bring ogbonge stability and transparency to the exchange rate fluctuations wey go benefit both BDC people and the general public.

Now if you wan talk say d two dey kind of similar, na only when Dem talk say 
Quote
how these new ideas wey the bdc, Bureau de change wan take affect our naira come improve am. Aside for that there's no similarities.

Please before we conclude abeg make we try dey check matter well. We no supposed come dey fight or use offensive tone for our talk we be one for here, Na the rules wey @ Igebotz talk be that one so let's chill and go back to the original topic of discussion.

 
RULES

  • Follow the rules and guidelines of the forum.
  • 1. Only Naija Pidgin and English is allowed
  • 2. Be respectful and polite towards others. Avoid using offensive language or making personal attacks.
  • 3. Stay on topic and avoid hijacking threads with unrelated discussions.
  • 4. Use clear and concise language and try to keep your posts brief and to the point.
  • 5. Check your spelling and grammar before posting.
  • 6. Avoid spamming or posting repetitive or off-topic messages.
  • 7. Do not post any sensitive or personal information about yourself or others.
  • 8. Respect the privacy of others and do not disclose any personal information without their permission.
  • 9. Do not post content that is illegal, or copyrighted/plagiarism.
  • 10. No duplicate thread/Topic is allowed.
  • 11. Be mindful of the tone of your posts and try to contribute constructively to the conversation.