When i dey read some people post the thing dey sound me like sey Dem they speak correct English but this our local board na pidgin English wey dey us talk here, make our people dey use pigeon dey talk here so that wey from naija go dey understand weitin we dey cap well well, if we wan use english talk, some oyibo dey read wetin we dey talk and some of Dem dey no watsup when we talk, so is good make we make sure sey the tins we talk e plenty for our pidgin pass the one wey we use corit English talk, this Tori wey I come tell my brother's and sisters wey dey there.
OP, your matter no bad o but dat one no matter now for this local board. Since dem say dey don already debate am before for the local board on which language dem go dey use for here and dem go mostly for both pidgin and English. Make e just be like dat for now. Me I know many people for dis our same naija wey no fit communicate for pidgin even if dem dey understand wetin dem dey yarn. The main tin na him be say make d person wey dem dey follow talk understand wetin dem dey yarn am.
Another tin wey dey important we wey b naija people suppose dey do, na to help our country people make dem grow becuz na una people go still help dem to grow, we no go expect make person wey from another country dey carry una brothers and sisters along, make una dey try dey show love the wey brainboss dey show people love for the community, make una know sey injury to one is injury to all, and when we urinate together it will come outside foam.
E no really mean say na person wey dey same local board with you go help you grow for forum. People dey comment and contribute for different boards, so dem fit get help to move up for d forum from outside. For dis local board, na only one merit source dey and e no dey really help our members for here grow like others. I believe say if we get more, the help wey you dey talk go come if you continue dey contribute for the local board wella like odas.