Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Make we help our self
by
Dzwaafu11
on 04/09/2023, 06:54:24 UTC
⭐ Merited by hugeblack (1)
When i dey read some people post the thing dey sound me like sey Dem they speak correct English but this our local board na pidgin English wey dey us talk here, make our people dey use pigeon dey talk here so that wey from naija go dey understand weitin we dey cap well well, if we wan use english talk, some oyibo dey read wetin we dey talk and some of Dem dey no watsup when we talk, so is good make we make sure sey the tins we talk e plenty for our pidgin pass the one wey we use corit English talk, this Tori wey I come tell my brother's and sisters wey dey there.

The local board no force anybody to speak the correct English, wetin they be say they don talk this matter both the two you guy speak anyone you like some people they wey no sabi pidgin English, therefore we no go force anybody say make them they speak pidgin English and normally anybody wey sabi pidgin English even if him no sabi the correct English person him go understand wetin another person they talk so make e just be as e they like this. So no be issue make we anyone wey we like eve me some times I dey mix am both two.


Quote
Another tin wey dey important we wey b naija people suppose dey do, na to help our country people make dem grow becuz na una people go still help dem to grow, we no go expect make person wey from another country dey carry una brothers and sisters along, make una dey try dey show love the wey brainboss dey show people love for the community, make una know sey injury to one is injury to all, and when we urinate together it will come outside foam.

If you wan rely for local board thinking that na for local board you go grow up for forum you wan miss road bedat na, other boards they wey be say if you do well you go get merits and naija local board na obvious say we lack merit wey we go use help each other so if merit no they wetin u think say we go use help each other bcuz if na topic to  teach one another them they for dix board so nothing remain, we fit go other place and focus we go grow for there.