When i dey read some people post the thing dey sound me like sey Dem they speak correct English but this our local board na pidgin English wey dey us talk here, make our people dey use pigeon dey talk here so that wey from naija go dey understand weitin we dey cap well well, if we wan use english talk, some oyibo dey read wetin we dey talk and some of Dem dey no watsup when we talk,
OP by now you suppose don sabi a lot about the forum and this Local board but e go de do me like say you no really know much about am as i de think. During the early days wey dem wan start something about where naija people fit de relate dem get some rules wey dem don set aside and we know say any gathering wey no get rules no de last. So dem come to conclusion say make pidgin and English be d general language for this board and if notice even for the country no be everybody sabi speak d pidgin well and English na general language for the country so i no see any reason why we go stop de speak English here.
And again na when you de do bad thing or talk bad things na im you go wan de hide wetin de hide make people no know wetin you de do and since we no de talk bad thing or go against forum rules why we no go want make oyinbo understand wetin we de talk. Na oyibo people get d forum so i no see anything wey wrong in understanding wetin we de talk. Even you sef fit go use translator go read wetin de happen for other local board but what’s the essence, though for educational purpose it’s good since you can learn something from them as well.
so is good make we make sure sey the tins we talk e plenty for our pidgin pass the one wey we use corit English talk, this Tori wey I come tell my brother's and sisters wey dey there. Another tin wey dey important we wey b naija people suppose dey do, na to help our country people make dem grow becuz na una people go still help dem to grow, we no go expect make person wey from another country dey carry una brothers and sisters along, make una dey try dey show love the wey brainboss dey show people love for the community, make una know sey injury to one is injury to all, and when we urinate together it will come outside foam.
To me everybody de try for here I understand the part wey you de go but people de try for here ooo. Love can come in different ways depending on the one wey d person fit offer you. If na merit aspect you de talk about, if you post wel I believe say you go earn d merit so make you still understand say merit begging is against the rules.