Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Make we help our self
by
Majestic-milf
on 07/09/2023, 18:19:29 UTC
I am hoping to start seeing your posts on Nigeria local board. Make your Pidgin useful.
I commend this approach, @Charles-Tim. E show say you nah OG for the game

@Onyeeze, I no expect you to para begin cap careless if wetin him dey talk truth dey becos e no insult you, e just make a clear observation. Them say charity nah girl Pikin wey dem born for house. If you no dey practice wetin you dey preach, then how you wan dey convincing to your listeners?
Your topic na "make we help ourselves" nah this behavior you put up wey go help?
If you no fit take constructive criticism, I wonder how you go take give am. This world dey small and no matter were we find ourselves, try respect the next person. You no fit lead if yoh no follow...
Oga the wey e put am with red color e no make sense at all, the tin come dey show sey maybe I no dey serious for local board, e first write beta something and cum edit am cum put read ink write up, if na you, you no go vex, for English board wey everybody dey write most it be sey we go write for every body or we go jump into discussion wey we no understand, people wey like to dey talk wetin dey like dey, but i no dey like to put mouth for wetin no concern me or something wey go bring problem tomorrow for were i dey. I only concentrate for wetin go make us grow, no be to dey bring query for our board
I understand the area wey you dey come from, but e get the way you go address the matter, him go understand wetin you dey yarn, but as you blow hot like that, e no go change anything and as nah im opinion be that, e go still stand. If you feel say he was rude with the way him correct you, you for privately message am, lay your grievances. You nah man and una get the way una dey reason tins. Two wrongs don't make a right. We nah one for this forum and make minor misunderstanding no break us... well done from this side.


I be woman o, no be oga biko 😁