...the proverbs wey Dobabe and Roseline492 drop don already dey for here I understand say dem no no.
Na true you talk. Thank you. I see am too and nor be only dem I don observe wey don do am. I get some people wey dey my radar. I nor wan rush enta dem, make e nor come be like sey we dey hammer dem harshly. My investigation dey on. The main purpose wey I take create dis thread nor be to dey spam put; but na so we go dey share proverb ideas so dat any time wey we talk for where elders dem dey, dem go confirm sey we sabi wetin we dey do. I hope una dey use am for real oh and nor be to just post to increase post count.