I hope una dey use am for real oh and nor be to just post to increase post count.
Baba dis one na big question o but I no fit answer for everybody because na only my self I know I no no how every other person take dey relate for the proverb matter. Yes I dey use am on daily basis but I dey only use am if I dey with men wey get akonuche and my fellow elders wey fit understand and relate because my people talk say person wey dem speak parable to come explain am the money wey dem use marry the person mama na waste.
Like yesterday wey I been dey with some elders for office, e get something wey we bin dey discuss as another person come inside the room all of use come dey use proverbs dey talk instead of the normal English language wey we been dey communicate with and we still understood each other.