Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: School drop out, unwanted pregnancy and divorced - my personal view on these!
by
rachael9385
on 30/09/2023, 18:40:53 UTC
It's always common to judge such people and even if you feel sorry for them, the moment you see them again, the first thing that comes to mind is that he/she is a dropout and you might even start looking down on them.

E no get wetin you go do wey people no go judge you, so you no support dey reason people judgement, dey do wetin you wan do wey go make you happy. If you wan drop out go chase your desire do am, I no think say people too dey reason that dropout matter again because now wetin dey rein na money not degree. You fit be drop out but provided say you make am fir life, nobody go dey reason you as drop out. Those wey finish school go dey wish say dem dey like you self. As for the divorce matter Nigerian never accept that culture yet that's why people still dey judge wen e happen but as I dun talk, no reason anybody matter, do wetin you feel is best for you.
My O.G @CryptopreneurBrainboss I support watin you talk, as we all be human beings so, nothing way we go do way pipo no go talk, imagine say them dey talk about person way done kpeme, so nah why dem no go for talk about person way still dey alive?
This matter way the op carry come, for me I go say nah just normal thing for life and no be only our country 9ja e dey, e dey for everywhere, and we also know say if we dey reason people mouth, the kind of things way dem dey alter out from am, my guy we no go fit go forward for life.
Op, your talk goes well Sha, but the thing be say all nah part of life, if I go as you, abi you never see person way after them Judge am finish letter that same person dem still dey celebrate am? Some of those things way people dey talk about person nah motivate dem dey motivate the person.