It's always common to judge such people and even if you feel sorry for them, the moment you see them again, the first thing that comes to mind is that he/she is a dropout and you might even start looking down on them.
E no get wetin you go do wey people no go judge you, so you no support dey reason people judgement, dey do wetin you wan do wey go make you happy. If you wan drop out go chase your desire do am, I no think say people too dey reason that dropout matter again because now wetin dey rein na money not degree. You fit be drop out but provided say you make am fir life, nobody go dey reason you as drop out. Those wey finish school go dey wish say dem dey like you self. As for the divorce matter Nigerian never accept that culture yet that's why people still dey judge wen e happen but as I dun talk, no reason anybody matter, do wetin you feel is best for you.
The truth be say anything you do for life people go always talk, because of wetin people go talk Don make many people do wetin dem no get strength to do. Like the school thing is not for everyone, infact the world Don change wey be say the world Don pass the system wey person needs to go to school be e go make money or succeed for life. The school thing no dey favour some people but because of wetin people go talk dem just dey force their self on school and nothing still dey come out.
For life no follow wetin people go talk, do your things and make sure say anything you dey do for life make you succeed, when you succeed people no go get wetin dem won talk again.