Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: INEC lament as voters shun PVC's in Kogi, Bayelsa and Imo states coming election
by
Smartvirus
on 30/09/2023, 22:54:04 UTC
No body wan waste their energy, time on sumtin wey dem know say las las e go end as selection process by INEC wit support from the bastardized court processes and judgement. ( He popular slogan: if u don't lik it go to court).

Many many people for social media don dey even say as INEC don destroy their credibility wit their own hands PVC, BVAS, IREV all don turn useless bcos INEC go still announce results in favor for who dem want as winner.
No be lie, the snake don bite and e bite deep and nasty. No be small faith our people don put inside INEC following there plenty declarations, promises and inventions just yo ensure credible election but, even INEC no fit follow en own laws, disregard international observers and credit just watin money buy from them.
Them don show Nigerians say them sabi sell market and as e be like that, Nigerians don learn say, no need to go dey price watin dem no go fit buy again. As them dey sell highest bidder for backyard like this, make them come in the open and dey sell am. No need to dey provide the crowd way them ho use as cover to dey sell there market.

There lamentation no be because of the cards, na say them no get crowd to use cover watin them plan sell. Na so I dey see am. INEC whirl enough power to change this country but, then just too selfish.