How una see dis matter. Is it possible say INEC fit redeem the trust people bin get for dem thru dis Kogi, Imo and Bayelsa states elections by doing the right thing as what ought to be? Or say na just same road dem go still take as dem do for the general elections? Abeg share ur thoughts with me!
De caption dey make me laugh. Why dem dey lament na, dem never see anything yet, no be wetin dem dey fine? So after dem don rig de last presidential election, INEC still dey expect people to go cue under de sun again, waste their time and energy so that camera go capture their faces say election take place and las las dem go do their thing. I bin think say this time around we go get am right but dem don successfully crush de spirit of many Nigerians and we no get fate again in INEC and de electoral process.
People really felt disappointed wit the attitude of INEC wey them use handle and conduct this past general elections. As in INEC no show any form of respect and fear for Nigerians based on how they worked hand in hand with this evil politicians at the expense of their own integrity and credibility, now them wan call pipul out again mk them use the pipul achieve their aim. If Nigerians go fit dey united to shun PVC's and act blind towards participating in election lik dis it go send a strong message to inec to work on their trust and integrity to mk pipol blib them again.