Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: INEC lament as voters shun PVC's in Kogi, Bayelsa and Imo states coming election
by
AYOBA
on 03/10/2023, 10:05:39 UTC
As Kogi, Imo and Bayelsa states elections draw closer INEC don dey lament say voters no even send to com out colet their Parmernent Voter's Cards (PVC's). And the headline com sound laughable wen I first read am but then at same time com send strong message say we Nigerians no longer get faith and trust for INEC. Meaning say, INEC no get beta reputation to stand on base on how dem use their own hand assist rig the just concluded 2023 general elections for we country.

My people's for kogi, Bayelsa, Imo states make una shine your eyes oo our Old grandpa give proverb say if your hand don enter Fire before next time if you see am you go run, so make una no go made mistake again she una see waiting dey happened for us in Nigeria present now. we waste our energy live time of our work go vote for them and at last dey disappointed us.

We be the one that excot them go and their left us at back, even does INEC people na the same position i dey keep them as de see say election don get close dey don start de move around of people say, may dey com collect their permanent voters card (PVC). After una carry them from Sun to shield now at end of day una go be the one that dey will take to Sun.