Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: School drop out, unwanted pregnancy and divorced - my personal view on these!
by
Marykeller
on 03/10/2023, 17:15:14 UTC
If you wan drop out go chase your desire do am, I no think say people too dey reason that dropout matter again because now wetin dey rein na money not degree. You fit be drop out but provided say you make am fir life, nobody go dey reason you as drop out. Those wey finish school go dey wish say dem dey like you self. As for the divorce matter Nigerian never accept that culture yet that's why people still dey judge wen e happen but as I dun talk, no reason anybody matter, do wetin you feel is best for you.
normally people eyes don de open to the reality say school or no school, na money everybody de find last last. The only issues be if you choose to drop out at any point e go first make sense say you de on funds because nobody go reason your matter again but majority of our students now an small children when be say before them go get mind make that kind decision, e go really hard them
I no sae na quote wey you be wan do give our boss "CryptopreneurBrainboss". I don help you arrange how em suppose be. Em go make sense make you edit your reply well so that peso go know sae you d quote peso.

Wetin I wan add for the subject matter be sae, as peso the think dropping out for school, make em d sure wetin em wan leave school for, worth am. No be dropout for school to end up creating nuisance for streets or joining bad gangs wey go d thief or dupe people of their money. If you check the number of people wey dropout from school, majority of them don commit themselves for one bad business to the other in search of money.

We know sae our country itself don fail us. As per person go spend years for university finish, come graduate and em no get work join after all the years, money and stress wey em pass to get a degree, still yet no available job waiting am. Upon all that we still get millions of Nigerians wey d graduate, year in, year out with hope of available job waiting for them(wey be sae millions of people wey graduate years back never get). On top that, them go still go meet those dropout for labor market controlling and working under them. That's the funniest part of it. Since a graduate go now turn out to serve a dropout.

As this thing the continue d go so, people are beginning to find school as a waste of time and resources, since peso go kukuma end up serving under peso well em d educated pass. Em go better make them dropout for school, so as to use that energy, time and money to go into learning a skill or establishing a business for themselves.