Government happily using NYSC as cheap labor to cover for our severely lacking government workforce. NYSC been lose its value since na why I no too get interest to do my own next year even if I go do am, I go restrict am within familiar territories.
Some members for national assembly don be create bill to abolish the program but e no go through. For me make them scrap am then gather the money wey dem go pay corpers each for that 12 months then carry am give each person make dem take help demselves. That go increase SME small even say electricity no dey. But government no go do am as na still part of them dey gey contracts for NYSC like the uniform, feeding/cow, beddings etc and na big money dey dere
Bam, you just hit the nail on the head. Government need to figure out a better plan with the program. One too many graduates don lose their lives in pursuit of serving their father's land. And the fact that there is nothing for nysc people to fall back on afterwards makes it harder for the program to make sense.