I don dey reason dis mata of Bitcoin in Nigeria and the way Govt dey make usage and operation a bit difficult and I come dey wonder weda e fit get a bit of breathing space if some of the big players in the business world pick interest in investing in them.
Una go agree with me say naija no dey completely against cryptocurrencies, Bitcoin especially but them no also dey friendly but just like the way El Salvador and Central African Republic take bold steps in making am dia legal tender, una feel say government fit relax some regulations on am if big cats for the business world like Aliku Dangote, Tony Elumelu and others decide to add Bitcoin investment to their portfolio?
Although this news nah old one oh but
Nairametrics believe say Dangote for be the 6th richest man in the world if say him bin invest 5% of him moni for Bitcoin. And I know say e no too late.
Another reason wey make me reason this mata say none of us be stranger to how fast the naira dey depreciate sharparly against the dollar and currently, 1dollar to naira for black market nah #1,009 as at time of writing and if we big ogas them fit do something, maybe e fit push the president to rethink him stance on Bitcoin because we need something wey go help our economic situation and so far, Govt seem to be running out of ideas.
How una see this one? Make we yarn.
The inflation and bad economy way Nigeria they face now dey very bad and heart breaking. If you come to think of it, every sector for Nigeria dey horribly affected and the thing dey get worse each day way pass by. The Nigerian govt de fully aware of how the operation of BTC as legal tender go help improve the economy and every other sectors for the common people, but they no send because, the govt way we get na for so-called famous and prominent politicians and the big cats you just mentioned which are inconsiderate, wicked and always want to be at the top of everyone. Na still the same thing way make we no fit refine crude oil in Nigeria.
The big cats and the politicians are not in any way affected by this economic situation and I dey fully convinced that them dey do BTC investment coded. If they leave narrow mind and thinking and accept BTC operation e go really help everyone. I just pray.