Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 3 from 2 users
Re: cooking gas now 1000-1200 per kg
by
Jegileman
on 10/10/2023, 15:25:12 UTC
⭐ Merited by Frankolala (2) ,Stable090 (1)
my country people, I just say make I bring this new as the thing really dey pain me Wella. the country matter don tire me and many off us don confirm say the country dey worst even more. just dis morning, as I come dey check news na e I see this one wey talk say cooking gas now na 1000 naira per kg and go likely increase for some places to 1200 per kg.

The price no be here oo but for my side I no dey buy am dis high sha. I no know why d price dey differ dis days for different places for d country. If dis one really happen na real gbese we go see for we country oo. Since when dis fuel subsidy removal happen, na so so skyrocketing of price we just dey see everyday. I even hear say d price of fuel for don move from N615 wey E be now to almost N1000 per litre if no be say the federal government still pay subsidy on top d petroleum price again. I just dey imagine now, which way naija, which way naija.

Quote
Another better source of household fuel Available(methane gas)by DubemIfedigbo001

this one na better and easiest source of gas wey I don hear about so far. I never try am sha but I go like make all of una try check am. Lastly, we should all add Nigeria to our prayers everyday because this country will not grow if we just sit down and don't do anything.
Quote
Concerning your new recommendation, I no too know about am sha, but I go do my own research about am, if e legit,  na him I go use, to minimize cost.

Me never still get believe for dis new method of using methane gas for cooking. D thing look kind of chemical tin and if d tin don reach dis stage, person suppose look into d advantage and disadvantages too. Methane gas na very volatile gas wey fit cause mass destruction if any leakage dey. So safety first before anything. Na very good method since e go reduce d cost of purchasing cooking gas but make we dey try find out d hazardous part of it too.

My brother me self I tire for everything, how can the country just be as if we no get leaders, everyday price of tins day skyrocket, just imagine gas wey I dy buy 300 naira when I start to use gas,  na only God go help us.

Just calculate how long since d day you begin dey use gas up to today. Economy don change na, even cost of living for dis people wey dey sell the gas don increase again. For any action today, reaction dey always follow, so d price increase get wey e look up to. If nothing don change since den, dat means d economy don stable be that. But d way e be so, economy still dey dangle first.