I wan use this topic take recommend another better alternative wey one of our members for nija board don drop with us for here to take battle these hard time together. I go advice make una also share Dem with una friend and neighborhood make Dem still try am if e go work for them.
Another better source of household fuel Available(methane gas)by DubemIfedigbo001this one na better and easiest source of gas wey I don hear about so far. I never try am sha but I go like make all of una try check am.
U dey recommend us wetin u never get testimony about?
E for make sense if u for tell us little about the technology operation instead of just telling us to go check through a link.
Here we ought to be logical interpreneurs and u know say the way u brand ur products or how u spice ur marketing gramatics dey attract public attentions and na from there customers dey take com that is even to when there is said to be doubts on the product.
Not every 1 here is likely to undergo clicking of links but at times the gramaticsal spices fit make am change mind.
Talking about say nobody knows wetin dey course the hiking na wetin me go say i get idea.
That na for more enrichment of the riches being them the political leaders and them in the political sector otherwise the legislative branches for kick against am because nobody go folo body lock himself with enemies and give oursider order say... Put us here on fire. Unless say na suicidal practition be that.
We get resources way dem dey take refine all these petrols such as Fuel, gas, kerosene and diesels and this resources na 1 of our biggest national trades way we dey take relax on our revenues so its increment rate in the international markets supposed dey be of our advantage cus we be suppliers but whether the value low or high, our govt go always get am to point at say e dey negatively affect our economy.