Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Educating Nigerians about Bitcoin
by
Youngkhngdiddy
on 31/10/2023, 09:40:52 UTC
As I started my bitcoin journey last month I observe say bitcoin knowledge is very backward in the country and bitcoin knowledge na wetin everybody go fit acquire in a simple way. According to wetin Satoshi Nakamoto talk bitcoin is for everyone and people who become part of the technology, and that's why I'm using p2p. I come dey wonder for naija way we so I no know for your area but for my area i no too dey hear bitcoin, the thing no dey popular for my area. Most people never hear the word bitcoin for their life self, so how we go do?
Last time I wrote about a topic will Nigerians marketers accept bitcoin if legalize. I saw different comments say them go accept, but to accept bitcoin no be the problem, them get the knowledge about bitcoin? Because wetin person no know big pass am by far. People need to get a solid knowledge about bitcoin first before using it and how to secure their coins/wallet if possible make them get guide wey go guide them through because if bitcoin dey legalize for naija scammers go dey invent new methods every day just like the way scammers dey for fiat.
In essence I wan talk say make we dey teach about bitcoin for our area because as bitcoin dey grow so countries go make bitcoin dey legalize as the world dey develop with different technology and Nigeria no go dey left behind, I believe say Nigeria go make bitcoin as their legal tender one day. So make we start to dey teach the knowledge about bitcoin so that the thing no go dey new for people ear.
  • students/children I have seen many threads on children education and I also want to contribute my view, one thing I observe about children them dey very sharp when it comes to learning especially learning about technology. I go like say make we start to dey teach the younger ones about cryptocurrency(bitcoin). Teaching them about the advantages and disadvantages about bitcoin, the risk involve and everything wey person suppose know about bitcoin. Some go say wetin concern small pikin and bitcoin, so as long as the pikin don know good or bad that pikin fit learn about bitcoin, so creating the awareness of bitcoin to our children is one of the best idea.
    Here are some threads about educating children about bitcoin:
     https://bitcointalk.org/index.php?topic=5438924.0
    https://bitcointalk.org/index.php?topic=5432314.0
    https://bitcointalk.org/index.php?topic=5454984.160
  • business owners: I think if you're a business owner maybe you're into selling of goods, clothes or supermakert, is best if you accept bitcoin as your pay in return. By so doing you're creating the awareness of bitcoin to your customers for example a school principal accepting crypto (bitcoin) as a school fees payment, he also stated that he believe that one day digital money will gain more acceptance than paper money so he wants to be part of the technology now.https://cointelegraph.com/news/nigerian-secondary-school-will-accept-crypto-payments-despite-regulatory-uncertainty
Lastly bloggers, if you dey into blogging, make your site dey talk about cryptocurrency(bitcoin), cause everyone makes use of the internet everyday.
  Na true say people gats get idea about people, no be everybody for this out country know say Bitcoin na something, people way day for all this remote village way no get access to phone or even internet bitcoin go be like strange word for them and e no suppose be like that because as promising bitcoin day everybody gats get idea about am. I thank the work of some of this company and crypto Community way day organize seminars and classes for people way no get idea to learn more. Na so ee suppose be more seminars need to day happen, I know say no be every part of niaja way get access to internet na there the fuck up come be cause at this technology era way we day so at least an average person suppose get phone way day browse, because without the internet even your knowledge self go waste.
  Bitcoin education day very important, plenty things day way we need need about the space. Plenty opportunities way fit change person life day inside the crypto space. We way get access to internet no need dull from this one. No allow laziness and ignorance do make you sleep on am. We don already see watin bitcoin do few years ago before we enter this bear market, way some people day regret why them sell their coin before it last all time high. Na because say they no get knowledge about am and they no see the potential way he bring. Now those same people don come back again hoping say it go skyrocket again. If to say they get the idea that time nothing for make them sell at that time. You see why Bitcoin/cryptocurrency education day important, knowledge no day useless ee go always day useful some day.