Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Come wetin we see about some Nigerian youths wey use smoking do work of they lif
by
Youngkhngdiddy
on 31/10/2023, 10:50:48 UTC
To add to wetin you yawn, people wey dey smoke don talk say weed dey make Dem reason well. I remember when dem interview mountain black and mad melon, nothing wey you no go hear about how weed take good and dey help give dem inspiration. Some weeders don also talk say e dey help dem sleep without hangover the next day and say e dey make Dem eat wella. Them say wetin make people dey misbehave and cause trouble when dem take am be say dem no dey eat and if you no eat, the thing dey worry the brain well well and if care is not taken the person go enter kolo levels.

However, that of ciga, me I never hear of any health benefit for that one if no be say your lips go dey black and your lungs too go dey affected according to wetin we don read about the effect of cigarettes smoking.
  People just get the wrong impression about this marijuana, some go even condemn you once day found out say you day smoke Igbo. But we don forget the health benefits way he day also bring, for yankee they don even legalize am because he good for people way get Parkinson. If health benefits no day am I no think a whole country like the united state for agree to legalize am. Doctors sef day prescribe am as drugs to some patients way get anxiety problem make them use calm their nerves. No quote me wrong smoking is actually bad for the health no doubt but it mostly depends what strain you’re on.
  We Nigerian we sabi over do our own thing, all these colos way boyz day do now no follow all this on don day tempered with na why ee day be like say he wan wound person, anything way day add chemical to enhance the reaction is not advisable for you cause even the chemical fit no day good for your body. If you wan know the benefits of smoking Marijuana enter google do research your self . Na why practitioners go advise smokers to de-toxify, as a smoker you suppose day take good care of your health and eat well so that you no be like person way suffer pass.