Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Educating Nigerians about Bitcoin
by
knowngunman
on 01/11/2023, 11:18:44 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
When you read an article, it is not everything you tok about. You only picked up topical sentence and discuss on it because other statements make up statement.

Quote
So lolz you don't have to crucify him. I believed I started my bitcoin teaching when was still young in the forum. When I was a Full Member last year.

Bro, be like say you dey get my message wrongly. I no crucify anybody with my earlier comment. I read the post and understand am wella and I also know wetin I replied. If you read well you can see that I even start my comment by first acknowledging his efforts. I said na true the guy dey talk and I continue with my opinion and even offer suggestion on how to go about it. I believe say na your comment make the guy wey I qoute below talk say I dey attack the op but that's very wrong.

Mr knowngunman I  no too blame you because of the way you attack the op,

I no attack the op, na just comprehension be the problem here I think. I no get strength to dey attack and rubbish person effort.

No get me wrong abeg, first if you read wetin I talk I no dey try say na me wan teach bitcoin for my area or anything, I gave some example about children, business owners and bloggers  even if I wan let person know about bitcoin na the little knowledge wey I know about bitcoin na I wan tell others, and even if i want to start i will start teaching my children first even you sef you never learn about bitcoin finish, knowledge na wetin dey endless, like I want make you understand me, I dey say make we dey create awareness about bitcoin no be only me, me and you make we start to dey create awareness.
Secondly shout bitcoin how, everybody fit fall victim to scammers na so life dey, so you dey try tell me say the area wey you dey them dey organize scammers to scam person or what. I no get

I understand your post bro and I know the angle you're coming from but I also know wetin I Dey talk. Na Nigeria we dey and we know how things dey be. One of my friend during my camp show us his account balance during argument and the guy was later attack on our POP day. Dem collect his phone and also force him to transfer the money which he no get option than to do. Na wetin I dey try talk be that. People believe say money dey bitcoin and when you begin talk about am dem go think say your wallet dey loaded. Na why I say you need to dey careful. And the truth be say majority of us here na single and even the ones wey don marry never get child wey don reach to learn bitcoin (15 years and above).

CryptopreneurBrainboss, Igebotz, Charles-Tim, Mpamaegbu, Issa56, Upgrade00, Agbe and the rest wey be senior men for this our board, I no fit call of una but I wan draw una attention to how we dey drag, attack and shade each other for this board. It's alarming and if anything dey wey una go do to address am e go make sense. I believe all of us are here for survival and putting sand for another person garri no go make your own garri sweet. The last thing I go do for this forum na to attack person for wetin no concern me. Most of the thread here get case of attack in one form or another. E no necessary but I need to talk am because the thing dey pain.

Our politicians don divide us outside the forum and I don't want us to be divided here. Abeg we need to coordinate ourselves and be a brothers keeper. Imagine one naija guy (the person go come across this post and he knows himself) wan the campaign manager to comot from the campaign. That's too bad bro. I don't know what you'll gain if dem remove me from the campaign. I no support crime, fraud or any other form of cheating but if you notice something unusual, why not pm the person and call his attention or for explanation?

The truth be say if we continue dey go like this with all this attitude of attacking each other, Omo we fit no go far ooo.