Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Educating Nigerians about Bitcoin
by
CryptopreneurBrainboss
on 01/11/2023, 13:54:06 UTC
but to accept bitcoin no be the problem, them get the knowledge about bitcoin? Because wetin person no know big pass am by far. People need to get a solid knowledge about bitcoin first before using it and how to secure their coins/wallet if possible make them get guide wey go guide them through because if bitcoin dey legalize for naija scammers go dey invent new methods every day just like the way scammers dey for fiat

In regards to that topic and your comment here, if na the knowledge we no get need to bother ourselves much because immediately the government legalize Bitcoin for the country, people dey wey go begin create awareness and projects go begin create awareness too for the country with sponsorship from their own project wey dem dey try sell as well. Make I just use MMM as an example, the ponzi scheme been dey the world since but Nigerian no know but as e enter the country people wey wan benefit begin promote am, I fit remember seminars been announced on radio stations regularly and this people dey teach people how to register and do others things. Even after the government come out dey condem am, people still dey come out in their numbers for this events to learn am. Checkout Bitcoin too, at a time seminar were also the norm of the town before the semi ban came wey come weak anything cryptocurency for the country so we no need to worry as people/startups dey we go do the needful and make the adoption by the marketers faster.

Quote
In essence I wan talk say make we dey teach about bitcoin for our area because as bitcoin dey grow so countries go make bitcoin dey legalize as the world dey develop with different technology and Nigeria no go dey left behind, I believe say Nigeria go make bitcoin as their legal tender one day. So make we start to dey teach the knowledge about bitcoin so that the thing no go dey new for people ear.

I get that believe too even though Bitcoin no become the official currency of the country (which looks impossible to achieve), I feel say at a point in history Bitcoin should be recognized and we are allowed to use Bitcoin legally as a alternative currency to naira. Like both Naira and Bitcoin go dey acceptable legally everywhere for the country and not we hiding to make payments in Bitcoin. Everything na gradual process sha and we need change our politicians to be able to achieve this as the more we get more technologically advanced politicians in power the more we go dey get better laws wey go favor the country in technology and development but when we still dey vote all this old old people for power dem go only dey take us backwards.